Na shout of “EndSARS” plenty young pipo for Nigeria dey scream as di #ENDSARS protest enta di second day for Lagos, Abuja, Ughelli, Benin and oda parts of di kontri.
Di youth dey demand goment to completely ban police unit- Special Anti Robbery Squad wey dem accuse of many brutality.
Meanwhile police for Abuja don arrest some of di protesters afta dem fire tear gas to drive dem.
#ENDSARS become di number one Twitter trends on Friday sake of wetin dey happun for Nigeria.
Nigerian, UK born Hollywood actor John Boyega join di movement ontop #EndSARSImmediately #EndSarsProtests #EndSARS #EndSARSProtest.
Actress Genevive Nnaji also voice support for #EndSARS
Meanwhile President Muhammadu Buhari go soon take action on top #ENDSARS protest and di action go dey in di best interest of Nigerians.
Na wetin Personal Assistant on New Media to di president, Bashir Ahmad tweet dis evening say di inspector General of Police don already brief di presido on di mata.
“EndSARS” Fotos across Nigeria
Nigerian Celebrity Runtown, Falz lead protest wey turn vigil for Lagos since Thursday.
Nigeria inspector general of police bin don ban di unit from doing stop and search duties and setting up roadblocks on Sunday 4 October as tempers boil sake of everiday harassment and police brutality wey many claim say na SARS officers dey commit.
IGP Mohammed Adamu also tok say members of the Special Anti Robbery Squad (Sars) must always wear uniforms but Nigerians want Sars to end completely so dem enta road do protests across di kontri.
Singer Small Doctor lead protesters for Agege Lagos to #EndSarsNow.
Chart-topping musician Davido also tweet: “My people need me …. #EndSarsNow.”
After receiving pressure from fans to publicly back di protests, DJ Cuppy also movement to #EndPoliceBrutality and #EndSARS.
Di EndSARS protest also take place for Ibadan
Some of di protesters tweet complain of say police tear gas wey dem call a peaceful protest.
As Nigerian youths enta road dey shout end sars, President Muhammadu Buhari receive briefing from National Security Adviser Maj. Gen. Babagana Monguno (Rtd), wey Coordinator Presidential Amnesty Programme Col. Milland Dixon Dikio (Rtd) escort to State House, Abuja on Friday.
Wetin be di background to di latest palava?
For years, videos wey appear show SARS officers extorting and assaulting civilians don spread for social media.
Last weekend Nigeria inspector general of police bin don ban di unit from doing stop and search duties and setting up roadblocks
Tori be say Nigerian youths and celebrities dey demand goment to completely ban police unit- Special Anti Robbery Squad wey dem accuse of many brutality.
“Ughelli #EndSARS Palava”
Di Nigerian police oga kpata-kpata, Mohammed Adamu don condemn di way #EndSARS protester attack police officers plus damage police operation vehicle.
Di police tok tok pesin Frank Mba for statement on Friday say di protesters bin attack and kill one police officer wey im name be Etaga Stanley and wunjure anoda officer Sergeant Patrick Okuone.
Di protesters also bin cari di gun of di dead police officer AK47 rifle wit 25 rounds of live ammunition.
Di IGP say police no go tolerate any attack on police officer by protesters.
Oga Adamu don order di Delta State Police commissioner make dem chook eye on top di mata and find out those wey kill di police Officer and make dem face di law.
Police for Abuja bin arrest some #EndSARS protesters after dem fire tear gas to disperse dem.
Di protesters wey be members of rights group, bin enta street to do we-no go gree and join oda Nigerians wey di ask goment to scrap di Special Anti- Robbery Squad.
Di protesters wey come out in dia numbers begin dia peaceful waka from Unity Fountain but as soon as dem reach di central area, police officers begin rough handle dem and begin shoot for air.
Brian Danis wey di lead di protest say dem bin gada for unity fountain and begin dia peaceful protest and dia destination na di police headquarters.
But as dem reach central area side for Abuja, police pipo begin dey rough handle dem and come begin shoot for air and protesters begin run – but odas wey get mind refuse to run.
But as dem stand, di police officers dem begin point dem and dem no get option than to run for dia life.
Police later release four pesins wey chop arrestby the police during the protest have been released. They were taken by the officers of the Maitama police station.
FCT police spokespesin Mariam Yusuf say according to information at her disposal, the protesters were dispersed with minimal force.
But di protesters insist say dia fundamental right to peaceful gathering n aim police try to scata even though dem bin dey peaceful and no get intention to cause chaos.
(Refresh dis page if you no see fotos)