Manchester City beat Arsenal 5-0 to win dem for di Etihad Staduim.
Ten-man Arsenal bin dey completely outplayed by Manchester City as dem fall go down to di bottom of di Premier League.
Na di first time since 1954 wey di Gunners don lose dia three opening games of di league season and dis match bin don over by half-time.
Na for di seventh minute Ilkay Gundogan head Gabriel Jesus cross to give di hosts di lead.
Feran Torres widen di gap 12 minutes inside di game as e take advantage of poor defending from Arsenal.
Arsenal palava worsen for di 35th minute afta Granit Xhaka chop red cad for im two-footed tackle on Cancelo
Since di begining of di 2016-17 season, dem never send off any player more often for di Premier League dan Granit Xhaka (Four, level with Fernandinho and David Luiz).
Gabriel Jesus for inside 43 minutes make am 3-0 against di Gunners before di end of di first half.
Rodri goal for di 53rd minutes amke am di first for di second half and further break any hope say Arsenal fit come out of dis before Torres header from six yards away for di 84th minute put di fianl nail for di coffin of Arsenal game for di day.
By di end of di game, Arsenal manage only one shot – off target – and 19% possession. Dem never still fit score for di Premier League dis season and immediately after di international break play with Norwich, di team dem replace for di bottom of di table.
This post is auto published using google feed service Source link . Team Palavanews has not published or verified the content of this article.