
Wia dis foto come from, Reuters
Di storm carry water from Lake Pontchartrain, for south-eastern Louisiana enta di ciity of New Orleans
Di US city of New Orleans no get light and na only generators dey work as Hurricane Ida dey hammer Louisiana.
Hurricane Ida land for di US state of Louisiana, on di 16th anniversary of Hurricane Katrina.
Di storm bring like 150mph (240km/h) winds with am wen e make landfall and pipo wey no run don get advise from authorities to take cover.
US President Joe Biden don say e fit take weeks for di electricity to come back and say Ida fit dey “life threatening” and fit cause ogbonge palava beyond di coasts.
See some ogbonge fotos wey shows as di Hurricane land
Wia dis foto come from, Getty Images
Ida carri heavy winds enta New Orleans
Wia dis foto come from, Getty Images
Mama dey comfort her grandpikin as di storm bin dey near New Orleans
Wia dis foto come from, Getty Images
Pipo dey waka for di French Quarter on Sunday for New Orleans
Wia dis foto come from, AFP
Pipo still dey waka up and down even though authories don ask pipo make dem find shelter
Wia dis foto come from, Reuters
On Saturday, pipo bin don already start to make plans in preparation for di storm
Wia dis foto come from, ESA/NASA
European Space Agency astronaut Thomas Pesquet bin take dis picture of Hurricane Ida on Sunday from di International Space Station
This post is auto published using google feed service Source link . Team Palavanews has not published or verified the content of this article.