Everiwia for Lagos (lives & properties worth billions) don scata afta jaguda pipo alias hoodlums hijack di #EndSARS protest for Nigeria commercial city.
Na violence full di last three days of wetin suppose be peaceful protest against police brutality AKA “EndSARS Protests” for Lagos and oda parts of Nigeria.
On Wednesday alone, jaguda pipo burn down police stations, one of di biggest television stations for Nigeria, popular public bus terminals wit plenti long (BRT) buses and loot banks, court, shopping malls wey dey locked sake of 24 curfew authorities order for Lagos.
Check di properties wey spoil for di violence:
Lekki- Ikoyi Toll gate and Lekki Toll gate
E no dey clear who set fire burn di Lekki toll gate and di Lekki-Ikoyi toll gate on Tuesday 20th October afta di shooting of protesters wey gada for dia.
But di whole incident start afta sojas go shoot at unarmed protesters wey want Nigeria goment to end police brutality and reform SWAT dat na one new police unit wey replace SARS.
NPA Headquarters for Lagos
Some hoodlums attack and put fire for di headquarters of Nigerian Ports Authority in Marina, Lagos on Wednesday, October 21, 2020.
According to some social media reports, di hoodlums dey para sake of say sojas go shoot unarmed protesters for Lekki Tollgate yesterday.
Sanwo-Olu family home for Lagos Island
Di Family house of Lagos state Governor, Babajide Sanwo-Olu no dey left out as report say some youths go put fire for di place on Wednesday 21st October.
Dis happun afa di Governor tok say no nobody die during di shooting wey sojas do for Lekki Toll Gate on Tuesday night. Dis come make angry youth go light fire for di Governor family house wey im mamma dey stay.
Television Continental (TVC)
Hoodlums attack Television Continental, TVC office building for Ketu, Lagos area of Nigeria on Wednesday 21st October. Dem burn equipment and cars.
one of di staff wey dey inside tell BBC say some pipo don escape go outside while some still dey inside.
Pipo start to notice say something dey off wen di TV station suddenly go off wen Morayo Brown wey dey present Your View tok on air say hoodlums dey di gate of di office.
Bus Rapid Transit (BRT) for Oyingbo, Yaba & Berger
Angry thugs also attack and put fire for mass transit buses wey belong to Lagos State goment for Oyingbo area for Yaba on Wednesday 21, October.
Di buses wey dem dey popularly call Bus Rapid Transit (BRT) dey park for di Oyingbo and Berger terminals.
Federal Road Safety Corporation (FRSC) office
Report say angry thugs also attack and burn di Federal Road Safety Corporation (FRSC) and Vehicle Inspection unit office (VIO) for Ojodu Berger area of Lagos on Wednesday 21, October.
Di FRSC unit dey share di same compound with di Vehicle Inspection unit. Report say di thugs burn some motor wey dey dia and destroy several properties.
Police stations
Lagos state Police tok-tok pesin, SP Olumuyiwa Adejobi say hoodlums kill two policemen for Orile Police Station, wound many for various stations and burn ten (10) police formations across di state on Tuesday 20th October.
E say dem loot di affected stations and tiff some valuables from dia. Some of di oda affected police stations include;
- Idimu,
- Igando,
- Layeni,
- Denton,
- Ilenbe Hausa,
- Ajah,
- Amukoko,
- Ilasa, Cele Outpost under Ijesha,
- disbanded SARS officer under Ajegunle,
- Ebute-Ero Mushin (Olosan) wia dem kill two policemen
- Ojo and Ajegunle wia dem burn two (2) patrol vans.
Banks, Secretariat and Medical centre
Also, on di 20th and 21st of October, hoodlums attacked three (3) new generation banks and tiff some amount of money while dem put fire for some parts of di bank before police arrest some of dem di loots from the banks, including arms and ammunition.
Police tok-tok pesin say for Ajegunle Area today, di hoodlums burn di Secretariat of Ajeromi Ifelodun Local Government Council and some valuables including cars; plus also attack some oda private medical and commercial centres.
Palace of Oba of Lagos
Today, Wednesday 21st October, 2020, di hoodlums attack di Palace of Oba of Lagos and carry im his staff of office go.
Report say dem destroy cars and tiff valuable properties wey dey di palace but di Oba of Lagos, Rilwanu Akiolu dey safe afta some team of armed soldiers come rescue am.
Shoprite Ajah and oda shops/malls
Lagos state Police tok-tok pesin, SP Olumuyiwa Adejobi tok for statement say hoodlum attack shoprite Ajah and g loots tins for many oda shops/malls.
Dis na afta di shooting of unarmed protesters wey sojas do for Lekki tll gate yesterday.
Lagos State, Magistrate Courts, Igbosere
Hoodlums attack di Igbosere High Court, Obalende on Wednesday evening 21 October stealing computers, printers, files, fans, air conditioners and oda items.
For one video wey dey circulate online, di hoodlums dey run around with different items and one of di thugs wear judge robe and wig plus carry machete.
Lagos state police tok-tok pesin also confam di attack.
Di Nation Newspapers office
According to di statement from Lagos state Police tok-tok pesin, SP Olumuyiwa Adejobi, hoodlums also attack di Nation news paper office today 21st October.
Lagos Oriental Hotel
Western Metal Products Company (WEMPCO) Group, owners of Lagos Oriental Hotel, on Wednesday condemn attacks on dia facility dem during di violence wey follow EndSARS protestfor di Lekki area of Lagos.
Taiwo Alli, Executive Director, Corporate Affairs, WEMPCO Group, inside one statement confam di attack on dia property by jaguda pipo alias hoodlums wey hijack di peaceful protest.
Oga Alli say di attack di hotel wey di jaguda pipo wey dey armed wit guns, knives and bottles, forcefully enta [Lagos Oriental Hotel], harrass some of dia security personnel and damage property.
Tins wey Governor Babajide Sanwo-Olu say dem attack
According to Lagos state governor, Babajide Sanwo-Olu, tins spoil on Tuesday 20 October, 2020 wen some unknown pesin go burn di Orile and Ilasamaja Police Stations.
Kasala also happen as some unknown pipo also burn down completely di Ajeromi Local Government Area offices followed by heavy destruction of property.
For di same Ajeromi Local Government Area, Ajegunle in particular, hoodlums loot tins from di branches of financial institutions and dem also try to enta Tincan Island Ports.
How di #EndSARS protest begin?
Di protesters begin dia demonstration on Wednesday, 7th of October afta Popular singer, Naira Marley bin call for protest but later postpone am.
But even as e postpone di waka, some pipo still come out dat day to protest and continue dia demonstration till date.
Wetin dey happun for oda parts of Nigeria?
At least 10 states across Nigeria (five for south) (anoda four for west) (and one for north central ) don impose 24 hour no movement order alias curfew sake of di #EndSARS Protest palava.
Tori be say anti-riot police unit of di Nigerian Police Force don collect marching order to immediately enta streets sake of violence for di #EndSARS protests.
Dis order wey land Tuesday afternoon from di kontri Inspector General of Police follow how di #Endsars peaceful protest wey youth for di kontri dey do to end police brutality from early October 2020 across Nigeria begin turn violent since dis week.